Donald Trump on blue tie, white shirt and black suit

Wia dis foto come from, Getty Images

US President Donald Trump don announce say di European Union and Mexico go face a 30% tariff on imports to di US.

E warn say e go impose even higher import taxes if any of di US trading partners decide say dem go retaliate.

Di 27-member EU - America biggest trading partner tok earlier dis week say e hope to agree a deal wit Washington bifor 1 August.

Trump sama tariff ontop oda kontris too.

For di letter wey dem send to European Commission President Ursula von der Leyen on Friday, Trump write: "We get had years to discuss our trading relationship wit di European Union, and we don conclude say we gatz move away from dis long-term-large, and persistent, trade deficits, caused by your tariff, and non-tariff, policies and trade barriers."

"Our relationship dey unfortunately, far from reciprocal," di letter add.

Di EU na regular target of Trump criticism. On 2 April, e propose a 20% tariff for goods from di bloc and den threaten to raise dat to 50% as trade tok bin pause.

Washington and Brussels bin hope to reach an agreement bifor a deadline of 9 July, but no announcements on progress don dey.

For 2024, di US trade deficit wit di bloc na $235.6bn (�202bn; �174bn), according to di office of di US trade representative.

Von der Leyen say di EU dey ready "to kontinue to dey work towards an agreement by Aug 1".

"Few economies for di world match di European Union level of openness and adherence to fair trading practices," her statement add.

"We go take all necessary steps to safeguard EU interests, including di adoption of proportionate countermeasures if ne dey required."

For im letter to Mexico leader, Trump say di kontri neva do enough to stop North America from becoming a "Narco-Trafficking Playground".

"Mexico dey help me secure di border, BUT, wetin Mexico don do no dey enough," Trump added.

Mexico respond to Trump threat on Saturday, wia e call an "unfair deal".

Trump tok dis week say di US go impose new tariffs on goods from some oda kontris like:

  • Japan,
  • South Korea,
  • Canada, and
  • Brazil,

Di tariff go also start from 1 August. Trump bin send similar letters to a number of smaller US trade partners dis week

US President Trump say e go impose a 35% tariff on Canadian goods from 1 August.

Dis na even as di two kontris dey try reach a new trade deal.

Di announcement also come in di form of a letter wey e publish for Trump social media platform Truth Social, along wit additional threats of blanket tariffs of 15% or 20% on most trade partners.

Canadian Prime Minister Mark Carney say im govment go kontinue to protect di kontri workers and businesses as dem head towards di deadline for a trade deal.

Trump don send more dan 20 of such letters to oda US partners..

A blanket 25% tariff don alreadi dey imposed on some Canadian goods, as di nation also dey hit hard by Trump global steel, aluminium and auto tariffs.

Although, e get current exemption in place for goods wey comply wit a North American free trade agreement.

Trump don also impose a global 50% tariff on aluminium and steel imports, and a 25% tariff on all cars and trucks wey dem no build for di US.

E also recently announce a 50% tariff on copper imports, wey go take effect next month.

Canada dey sell about three-quarters of dia goods to di US, and na auto manufacturing hub and a major supplier of metals, wey make di US tariffs dey damaging to dose sectors.

"As you dey aware, tariff no go dey if Canada, or companies within your kontri, decide to build or manufacture products within di United States," Trump tok.

E also tied di tariffs to wetin e call "Canada failure" to stop di flow of fentanyl into di US, as well as Canada existing levies on US dairy farmers and di trade deficit between di two kontris.